The Creed of Life; NPC #Episode 3

in #npc7 years ago

As I see this creed ehn,I come reason plenty things wei dey happen for this life.

I throw way salute to @ogoowinner, for how you take reason this kind thing,God bless you wella.

Naija Pigin Challenge
IMG-20180128-WA0026.jpg
Image source
https://goo.gl/images/Z1YiHp
I believe say everypesin wey dey this life get right to be seen,make pesin love am and hear am.

I believe sai everypesin wei dey for this world na dey same.

I know sai for this world wei we dey,space dey enough for everybody,so no dey try to push pesin down.

I sure sai everybody get area for ein life wei dem do wella.

I know sai everybody for this life dey special for ein own way,even as me dey special.

I know sai everybody get that side of am,wei fid make am behave "gragra" and "jeje",so I go try bring out the part wei we go dey jeje like angel.

I believe the place wei I come from,the belief wei I get and the place wei I dey for life,na things wei fid cause division, so me I go first be human,before all those kind thing come join.

I go treat everypesin as I go like make them do me too.

I no go respond to people base on who dem be,but as who me go like make them become.

I no go join hand for anything wei go cause anoda pesin sorrow.

I go try to understand pesin action,no be to dey judge am.

I no go allow make long-throat,envy and those kind yeye things control me.

I believe everypesin go do wetin ein wan do for life,na just time mata.

I go try do something wei go stand tey for this earth,before I follow baba God for heaven.

I go try my best to no shake,wen things no go wella for me or the way I plan am.

I no go allow make fear bring me down.

I no allow make negative and yeye thoughts occupy my mind,I go quick replace am with beta thinking,cause sai " na wetin pesin think too much,naso ein go do"

I go always be me,no be to try copy another somebody.

I believe I fid do better something wei go stand if I do am with all my power.

I standa with Peace

I stand with free giving.

I believe make we dey forgive wella.

I know say na love sure pass.

I believe make everypesin get ein reward and justice

I believe make we dey do something with kind mind

I standa gidiba with human race,cause I know say e go beta.

I don decide sai I go "live" no be to just "exist".

I @willizgallery go abide by this principles as Baba God keep me alive.

Thanks for stopping by,don't forget to upvote,comment and resteem. I will appreaciate.

Sort:  

I love your language
Keep on inventing those slangs

Thanks dr,glad you love it

Thanks dr,glad you love it

This Na correct yarns.. God go help us run am well