THE CREED OF LIFE NPC ; EPISODE 3
I believe say all man or babe get the right make other people sabi them hear wetin them get to talk and love them
I believe say all man or babe na the same
I believe say this world boku so tey it fit contain all man or babe
i believe say all man or babe get the are wey normal person no go fit challenge them
i believe say all man or babe dey stand out from another
i believe say all man or babe get the karashika side and the angel side for their body so, me i go try my best starve my karashika and hail my angel
i believe say your race, who you dey kneel down to every morning, or the level where your village people dey put you no mean anything them just be wetin man dey use control another man, cause wahala and make pesin reson say he pass another person, but me i go respect human being frist before i go reson all those ones
i go dey do people as i want make them dey do me
i no go dey relate with people based on who them be, but based on who i for like make them be
i no go chook leg for anything wey go pain another pesin
i go try my best make i dey reson wetin person dey do no be just to judge them one hand
i no go let bad belle direct wetin i wan do
i go do one better thing for humanity before i kpai
i go still get my strong bodie.. even when so so misfurtune dey find me
i no go let fear hold me from doing wetin i wan do
i no go let bad belle last long for my head, i go quickly replace am with jolificating things
i go always be original bobo.. i no go try be another pesin
i sabi say i fit change something so i go always give m y 100% everytime
i believe say this life na journey, everybody get where them they go, no besay we dey rush go the same end point, so i no go dey compete with anybody
i believe in peace.. e no get how else i wan talk am
i believe say if i get i suppose give those wey no get the leanest
i believe say i suppose dey allow person wey don fuck me up go scott free
i believe in yori yori
i believe say wetin dey good for boma also dey good for belema
i believe in our hustle
i don decide say i no go just dey , but i go experience everything for life so
My name na Babajide Obidigbo and na the above laws i go dey live by till i kpai, i don talk am
make una follow me declare make we enjoy this world together