NAIJAPIDGIN HOTSEAT WITH @DRIGWEEU

in #naijapidgin7 years ago (edited)

My ogbonge Naijapidgin people I greet una oo, hw una dey take enjoy this weekend,
We know how today de be, after the church things and NASFAT for our fellow Muslim brodas place.
Make una sha dey joli dey go, God go answer we prayers...

Se una don hear Sha, after the flexing today; Naijapidgin hot seat na today for 8pm

Sharp reminder about coming election

Go collect your PVC, this 2019 real for this naija..

Gbam! Hotseat loading....%

image
As e b so na @drigweeu nai de for our hotseat show today, well it go be as it dey be nooni, much fun, entertainment and lot more.

@drigweeu na one kain ogbonge chef priest and native doctor... No just try de guy fit cook up vote juju for u.

I believe say some stéemian go know @drigweeu for his timely juju wae him Don cook for @camzy and @ewuoso

Make you just follow us come we discord channel where e dey happen and no forget to arrange your question for him too.

You no suppose miss am o, I promise you say d show go hot die, as for me I dey dere live.
Come meet @drigweeu for discord this evening, insha care he no go disappoint you.

Time: 8.00 PM sharp

Venue : @naijapidgin discord https://discord.gg/XSFyfPJ

Na @mittymartz carry dis post come for @naijapidgin

Nah @mittymartz gives dis fine avarta
IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Odogwu Igwe.... 😁😁😁😁😁

Congratulations @naijapidgin! You have completed the following achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

You published a post every day of the week

Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

To support your work, I also upvoted your post!

Do you like SteemitBoard's project? Then Vote for its witness and get one more award!