@NAIJAPIDGIN hotseat with @camzy
Source what'sapp
My pipu, my pipu, hw una dey, hw una dey take enjoy this weekend,
I know say na church things dey load for we Christians house and NASFAT for our fellow Muslim brodas place.
Make una sha dey joli dey go, God go answer we prayers...
Se una don hear sha,
If u neva here, make I gist u sharp sharp
Go collect your PVC, this 2019 real for this naija..
Gbam! Hotseat loading....%
As una don dey smell am say na @camzy we wan host for we hotseat show today, well it go be as it dey be nooni, much fun, entertainment and lot more.
@camzy na one kain ogbonge male steemit icon wey we sabi for naija here,
I believe say some stéemian go know @camzy for his art and toon works. Impresive sha..
Make you just follow us come we discord channel where e dey happen and no forget to arrange your question for him too.
You no suppose miss am o, I promise you say d show go hot die, as for me I dey dere live.
Come meet @camzy for discord this evening, insha care he no go disappoint you.
Time: 8.00 PM sharp
Venue : @naijapidgin discord https://discord.gg/XSFyfPJ
Na @zizymena carry dis post come for @naijapidgin
Na @mittymartz design dis avartar
Hello naijapidgin!
Congratulations! This post has been randomly Resteemed! For a chance to get more of your content resteemed join the Steem Engine Team
Its amazing support
I usually just post memes. LOL